WIZKID REACT TO PRESIDENT HUMAMMED BUHARI TWITTER ACCOUNT BEING SUSPENDED



Ban on Twitter, Facebook, Internet Shutdown and online censorship no be new tin again at all.

Yes o! Authorities for some kontries don bin carry out dis actions before, particularly to suspend Twitter.

Nigerian goment na di latest to to ban [Twitter] di micro blogging site operations for undermining dia goment alias 'interference'.

One report for 2018 don reveal say up to 22 African goment don order network disruptions for di last four years.

Na Di Collaboration on International ICT Policy in East and Southern Africa (CIPESA) bring out dis report.

And since 2019 Algeria, Democratic Republic of Congo, Chad, Gabon, Sudan and Zimbabwe - don experience internet shutdowns

Nigeria ban Twitter

On June 4 2021, federal goment announce di suspension of operations of Twitter social networking service for Nigeria, indefinitely.

Right now many users across di west African nation dey struggle to access di micro blogging site after di goment suspension.

Latest tori be say phone companies like Airtel and MTN don receive order told to block Twitter site.

But some pipo still dey access di site for some wi-fi networks.

President Muhammadu Buhari administration say di organisation undermine Nigeria goment.

Federal goment say dia decision na sake of di "constant use of Twitter for activities wey fit damage di kontri corporate existence."

Dis ban dey come just two days afta Twitter bin delete one tweet from President Muhammadu Buhari.

Di deleted Buhari Tweet bin mention di Nigeria civil war and warn those wey dey attack goment buildings.

[Twitter ban] See kontris wey don suspend Twitter

China

For 2009, China block Twitter for temporary.

Na afta small group of Muslim ethnic minority (Uighurs) inside di kontri use di site to exchange information.

Di message wey dem share for di micro blogging site later lead to serious riot for Xinjiang.

Afta di goment take dat decision many pipo for China begin use VPN to access Twitter.

Later on, authorities come officially block twitter togeda with Facebook and oda social media platforms.

Turkey

For 2014, Turkey block Twitter.

Turkish telecommunications regulator cite one court order to apply "protection measures" on di website.

President Recep Tayyip Erdogan wey bin promise to "wipe out Twitter" say e no care wetin di international community go tok.

But presido Erdogan later lift di ban for April 2015.

Egypt

During di 2011 protest for Egypt, Twitter claim say authorities for di kontri block dem.

But di Egyptian goment deny say dem no take any action to restrict use of twitter.

Herdict, one project from Harvard University wey dey collect data about websites wey dey down, write many reports say Twitter dey down during di protests. But afta one week, pipo come later fit tweet.

North Korea

North Korea start to dey block Twitter and oda sites for April 2016 - and previously for late 2014 - to stop di spread of information.

Infact Internet access for North Korea dey restricted to small section of di top ogas wey must receive state approval to use am

Most Pipo for dis kotries wey dia goment ban Twitter dey either use VPN or alternative social meida platforms like Weibo as in di case of China

Virtual private network (VPN) dey help pesin browse di internet anonymously (Without no identity).

E dey allow pesin get access to content wey authorities don block for im kontri.

[VPN] - How to use Virtual Private Network tweet

Di way VPN dey work be say e go connect your computer or device to di network of anoda organization wey dey provide di service.

Wen you use VPN, all of your Internet communications dey packaged togeda, encrypted.

And then send to dis oda organization, where dem go come decrypt, unpack, and then sent am to dia destination.

So to any oda pesin for di wider Internet, e go look like say you dey browse from inside di organization and not from your location.

Individuals dey use VPN to bypass local censorship, or defeat local surveillance.

But di risk wey dey for using VPN be say your privacy no dey guaranteed online.

Dis na as e be say di organization wey get di VPN fit see everything wey you dey do.

ICT expert, Akinseyin Kehinde explain say if di organization wey dey provide di service get hidden agenda.

Dem fit install bug inside your system to gada data, spy on you or take control of your oda online activities apart from di Twitter use. Kehinde add.



Post a Comment

Previous Post Next Post