Stingy Men Association: SMAN trend, [Stingy Women Association of Nigeria] Nigerian celebrities wey join - See di full gist

Stingy Men Association" of Nigeria trend gada momentum when Don Jazzy, Nigerian record producer wey real name be Michael Collins Ajereh join di movement as 'Head of Union'. Many begin wonder whether di "Stingy Men Association" dey for real? Kack make BBC Pidgin tell you di koko about dis latest trend among Nigerians. How [Stingy Men Association] start? Dis trend of 'Stingy Men Association don earlier start for Zambia for East Africa as a social media trend, wia Zambia men pledge not to spend pass K5 Zambia currency on dia girlfriend but better to invest it and earn interest. One man bin allegedly assault im wife ova money worth K150 afta im continuously claim say im be S.M.A.Z member ( Stingy Men Association of Zambia), according to tori pipo for Zambia Observer. Di man wey dem identify as Mr Loenard Mweembe bin chop arrest afta im assault im wife Mrs Mwembe sake of say im ask for money to make hair. Di Zambian Observer also for one of dia reports in November, 2020 claim say di members of SMAZ buy 800 capacity plane for dia members from money wey dem save . Wetin Stingy Men Association of Nigeria dey about? Di Stingy Men Association of Nigeria na new men movement and social media trend, wey be like something to create fun amongst social media users in Nigeria. For inside di form wey dem create, di association state dia objective na to uphold di dignity of di great association by not giving and money by any means of financial exploitation to di odar gender. Dem promise not to dey financially committed to women wey dem dey in relationship with. Nigerian celebrities wey don join For one Twitter post, Don jazzy post picture of im ID card belonging to di association wit di caption "Registration complete".
Nigeria Musician, Paul Okoye AKA RudeBoy also join di association as im post wetin im call 'temporary' ID card as member.
Social media influencers and some other Nigerian men don also show interest to join di movement of men wey no wan spend money for women wey dem dey date, wit inscriptions for dia 'supposed' logo saying "Dont give shi shi"( No give any money).

Post a Comment

Previous Post Next Post